Saturday 21 September 2013

AREA

For area wey we dey, see enof crib for paddy
Ajebo wey hate us call am ghetto
Say na shacks and kpako so so full am
But na them papa no wan make e beta for us

When morning show tear rubber
Wey pale gas hustle and mama set for shade
Guys go come dey hail levels wey dry
E go even dey like say them hail visa for jand

Later, chikala go roll out from lungu
She go look for guy with End Of Discussion
With small knosh and beer for her belle
Na six rounds him go knack

Boys for area just sabi kposh
Them wey wise go play ball
Girls go only throway belle yakata
Bastards go come yanfu for area

When night come, light no go dey
Na chance for boys to go steal be that
Papa sef go still dey joint dey booze
With fear, na our Lord's prayer mama go hail

2 comments:

  1. Funny but Sad- the no light part got me, and the bastard kids in the area.. Nice but true in a really funny way. Ized

    ReplyDelete
  2. Great stuff. Never read a poem in pidgin, this is a good first. Like the way it read funny even though that reality is sad. Well done.

    ReplyDelete